Di kloud dey between Egypt pipol kamp and Israel pipol own. Di kloud make evriwhere dark for Egypt pipol, but give lite to Israel pipol, so dem nor fit near each oda till day break.
I si sometin wey bi like fire wey dey burn from en waist go up. And from en waist kom down, I still si sometin wey bi like fire wey dey burn and di lite wey dey round am, dey shine well-well.
Dis God nor fit die and E dey stay for lite wey nobody fit waka near. Lite wey human being neva fit si. Make all honor and pawa bi en own forever and ever. Amen!