Even bad animals go honor mi; jackals and ostrich go praiz mi wen I go make river flow for di desert, so dat di pipol wey I choose go get wota to drink.
Una go komot from Babilon with joy and dem go lead una komot from di town with peace. Di mountins and hills go dey sing and di trees go dey shaut with happiness.
Wen E stop, di eart go start to shake and wen E look, di nashons go bigin fear. All di mountins go skata; di hills wey dey since go sink and E go dey forever and ever.
Di priests wey karry di Kovenant Box kon komot from di river centre and as dem just enter dry land, di wota for Jordan kon start to rush well-well again.