Pesin wey dey spoil pipol waka nor betta pass doz wey don die, bikos nobody spoil am. Di pesin wey dey deceive odas nor betta pass who don die, even doh nobody deceive am. Wen yu don spoil and deceive pipol finish, oda pipol go spoil and deceive yu too.
But naw, doz wey distroy una, dem go distroy dem too and dem go karry all una enemies go Babilon as prisonas. Dem go opress doz wey dey opress una and doz wey tif from una, dem go tif from dem too.
(Make una listin! Pipol wey nor get house dey run komot from Babilon go Jerusalem kon tok as di Oga awa God ponish Babilon pipol, bikos of wetin dem do to en temple.)
Dem go distroy en horse and shariot. Sojas wey dem hire from oda land, go dey fear and dem go weak like woman. All dia betta-betta tins go skata and pipol go tif and karry di ones wey remain.
Yu just dey busy dey buy and sell and dis tins kon make yu dey misbihave and kommit sin. So I ask yu make yu komot from my mountin wey dey holy and di angel wey dey guide yu, porshu yu komot from di stone wey dey inside fire.
Dem nor nid to go gada wood for di field or go kut tree for forest, bikos di swods go rish dem take make fire. Doz wey tif and karry my pipol propaty before, my pipol go kollect di load back from dia hand.” God wey get pawa don tok.
Just as una distroy Lebanon, na so too dem go distroy una finish. Una kill all di animals wey dey der, but naw, animals go worry and kill una. Dis tin go happen, bikos of di pipol wey una kill and di wahala wey una kause for dis world.
God go bring wiked diziz kom all di nashons wey fight against Jerusalem. Dia flesh go dey rotin even wen dem still dey alive; even dia eyes and tongue go rotin too.
Dem dey kry with loud vois sey, “Oga God wey get pawa, how long e go take before yu go judge doz wey dey live for dis eart? Make yu ponish dem, bikos na dem kill us!”