Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Habakkuk 2:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 Den pipol wey una dey whole money, go kom kollect dia money. Dem go turn face una kon take evritin wey una get.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Habakkuk 2:7
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

If yu nor dey gri take korreshon, one day yu go fall and yu nor go fit stand again.


Anybody wey dig pit for odas, go fall enter by ensef and pesin wey break wall pass, snake go bite am.


Efraim pipol nor go jealous Judah pipol and Judah pipol nor go hate Efraim pipol again.


I don choose one pesin from east, I go bring am kon attack una from di nort and e go mash una just as pesin wey dey mold tins, dey mash klay.


I koll one eagle kom from east; from one far land, di one wey dey kom do wetin I plan. Just as I tok, na so e go bi and wetin I plan, must happen.


So, wahala go kom meet yu and yor majik nor go fit help yu. Wahala wey yu nor espect, go happen to yu at wons! Even trobol wey yu nor tink of, go rush kom meet yu like wota.


So God go use Media kings take distroy Babilon. E go revensh bikos of en temple wey Babilon sojas distroy. Media sojas oga kon kommand sey, ‘Make una sharp una arrow and karry una shield!


I go make en ofisas, wise men, leaders and sojas drink anyhow. Dem go sleep and dem nor go wake-up again. Mi, wey bi God, don tok. I bi di Oga God wey dey mighty.


God sey, “Yes! I dey send enemies kon distroy una and dem bi like wiked snake and nobody go fit stop dem. Dem go wound and kill una well-well.”


Wen pipol dey sey, “Evritin dey okay and peaceful,” na dat time wahala wey go skata evriwhere go kom and e go bi like di pain wey woman dey face wen e won born and nobody go eskape from am.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ