Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Habakkuk 2:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 Si proud pipol, all wetin dem dey do nor dey good for my eye. But doz wey dey do good, go get long life, bikos dem dey obey my laws.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Habakkuk 2:4
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

For dis life, dem dey happy sey dem get evritin kon dey klap for dia suksess,


God sey, “I go bring wahala kom di eart and I go ponish all di wiked pipol, bikos of dia sin. I go make anybody wey dey proud, honbol and I go ponish evribody wey dey sturbon and wiked.


Pesin wey dey obey my kommand and keep my laws well. God wey get pawa sey, dat kind man dey raitious and e go get long life.


E go dey happy for en viktory and all di many sojas wey e kill, but e nor go always dey win.


E kon sey: “Dis nor bi di great Babilon wey bi di royal town wey I build by mysef to show my pawa, strent, glory and honor?”


Naw, mi Nebukadnezzar praiz, woship and hail di King wey dey heaven. Evritin wey E dey do dey rite and en ways dey pure. Pipol wey dey karry body up, E dey bring dem down.


“I tell una true word, na di tax kollector God go forgive, nor bi di Farisee. Bikos anybody wey karry ensef go up, God go bring am down, but di pesin wey put ensef down, God go karry am up.”


Pesin wey bilive di only pikin wey God get, go get life wey nor dey end. But pesin wey nor bilive Man Pikin, nor go get life at-all. God go always dey vex with dat kind pesin.”


Bikos na di Gospel dey show how God dey take make pipol klean for en eye. From di biginnin go rish di end, God sey, “Na only faith go make pesin dey klean for my eye.”


Wi know sey nobody dey free from God judgement, bikos na so di law tok and pipol go only dey free, if dem get faith for Christ. Since wi don bilive Christ, wi suppose to dey do good thru di faith wey wi get for Christ and nor bi to dey do wetin di law tok and wi nor go dey free from judgement, wen wi do only wetin di law tok.


E go oppoz and karry ensef pass God and oda tins wey pipol dey woship. E go even sidan for God Temple dey tok sey e bi God.


My raitious pipol go live and bilive, but if anybody turn back, I nor go dey happy with am.”


For di same way, make una wey yong put body down for di eldas. Make una nor dey karry body up for each oda, bikos God dey oppoz proud pipol, but E dey favor doz wey dey honbol.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ