Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Habakkuk 1:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 Why Yu allow mi dey face dis kind trobol? Must I si all dis wahala wey dey happen to mi? Anywhere wey I look, na only wahala and distroshon I dey si. Na pipol wey love to kworel and fight, dey round mi.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Habakkuk 1:3
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Den I tink of all di wiked tins wey dey happen for dis world. I si pipol wey dem dey opress, dey kry and nobody dey to help dem. Nobody dey to save dem from doz pawaful men wey dey opress dem.


Nor sopraiz wen dem dey opress poor pipol or as bad judgement dey kover good judgement. Dis na bikos, di lowa ofisas must do wetin dia senior ofisas orda dem to do.


So, una wey sturbon and nor dey do di rite tin, make una listin to mi.


Na Israel pipol bi God vineyard, why Judah pipol na di good vine wey E plant. E espect dem to do good, instead dem dey do bad and kill pipol. E bin dey wait to si weda dem go do wetin dey rite, instead pipol wey dem kill, dia blood dey kry go meet God.


I kon sey, “Si as I dey vex! Wetin make my mama born mi at-all? Must I kworel and argue with evribody for di land! I neva ever borrow from pesin or borrow pesin money, yet evribody dey curse mi.”


Why dem born misef? Na make I for si trobol and always dey kry, so dat my life go end with shame.


Na only bad-bad tins and deat I dey profesy about. Na only curse and trobol yor message don bring kom meet mi.


But yu, my pikin, even doh dem beat and do yu anyhow like sey yu dey stay with skorpions, make yu nor fear dem or anytin wey dem tok. Nor fear anytin wey dem tok or di way wey dem go dey look yu, bikos all of dem sturbon well-well.


“Si! I dey send una go like sheep for where plenty wiked animals dey, so make una dey wise like snake and gentol like dove.


(bikos di time wey Lot dey dat town, e vex for di bad tins wey di pipol dey do).


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ