Like lion wey hide for korna, na so dem dey wait to kill innocent pipol. Dem dey katch and drag innocent pipol for dia net like hunta wey katch animal.
“But for naw, mi, wey bi God, dey sey: ‘I dey send enemies wey go katch dis pipol like man wey dey katch fish. Afta, I go send oda pipol wey go katch dem like huntas for mountins, hills and holes for rock.
God sey, “Babilon pipol! Una tif from my pipol and e dey make una happy. Una dey enjoy like animal wey dey chop betta green grass. Una dey sing with joy like di nois wey horse dey make.
“Man pikin, dis na wetin Tyre pipol dey tok about Jerusalem. Dem sey, ‘E get pawa before bikos of en money, but naw wey di town don skata, wi go get plenty money kon strong pass am!’
just as una dey happy wen Israel skata; Israel land wey bi my own. Mount Seir pipol and all of una for Edom go die finish. Den evribody go know sey na mi bi God.’ ”
True-true, wine go disgrace proud and wiked pipol! Dia mout wide like grave and just as deat nor dey beleful, na so too nor-tin dey beleful dem. Bikos of dia long-trot, dem don gada nashons kon swallow many pipol.
but make dem nor for kause trobol, make yu go trow hook for river. Di first fish wey yu go katch, wen yu open en mout, yu go si money for inside, den make yu take di money pay di tax for mi and una.”