Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Habakkuk 1:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 Dem dey ponish kings and use dia leaders make yeye. Dem dey laf all dia strong-strong towns. Dem dey kover towns with san-san kon seize dem.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Habakkuk 1:10
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

King Jehoiashin for Judah with en mama, en savants, ofisas and all en kourt workers and priests kon surenda to King Nebukadnezzar. For eight years wen King Nebukadnezzar dey rule for Babilon, e kon put Jehoiashin for prison.


Wen di year just start, King Nebukadnezzar kon give orda sey make dem bring am with di betta tins wey dey for God Temple kom Babilon. E make Zedekaya wey bi en family memba, king for en place for Jerusalem.


King Nebukadnezzar for Babilon attack Jehoiakim, use bronze take shain am kon karry am go Babilon.


I don win Kalno, Karkemish, Hamat and Arpad towns. Yes, I still win Samaria and Damaskus pipol.


Dead body dem go look yu kon ask demsef, “Nor bi dis man bin dey shake di eart kon make kingdoms dey fear?


Where di king dem wey dey for Hamat, Arpad, Sefarvaim, Hena and Ivvah town?”


“I dey hear as una dey kry, bikos of una fear and di wahala wey una dey face.


Si as Babilon pipol build dia kamp round di town and dem won seize and attack am. Dem go win, bikos war, honga and diziz don already dey kill yor pipol. Naw, make Yu si sey evritin wey Yu tok, don dey happen.


Mi, di Oga wey bi Israel God sey, war and wahala go skata all di house for Jerusalem and di royal palis for Judah.


Una go feel my vexnashon like hot fire. And I go give una to wiked men wey sabi distroy tins.


E go distroy una land, den e go attack una kon build wall round una town.


God sey, “For judgement day, I go ponish Judah leaders, all dia prince and all doz wey dey sin.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ