Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Galatians 6:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 Instead of una to dey kompare unasef with anoda pesin, make una shek unasef, den una go fit tok about unasef.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Galatians 6:4
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Even if E kill mi, I go still dey bilive am; I go still tell am wetin dey do mi!


O my God, make Yu look mi well-well, den test my heart, so dat Yu go know wetin I dey tink.


Just as doz wey dey judge odas dey get wetin dem deserve; na so too good pipol dey get dia reward.


Di Farisee kon stand dey pray about ensef sey: ‘God, I tank yu sey I nor bi like oda pipol wey dey play wayo, dey sin, pipol wey dey kommit adultery or even like dis tax kollector.


So make evribody shek ensef, before e chop di bread and drink from di cup.


God go reward us if di fire nor burn wetin wi build.


Di pesin wey plant di seed and di one wey wota am, na di same work dem dey do, but each pesin go get en pay from God akordin to en work.


Wi dey happy, bikos wi know sey di way wi dey live awa life for dis world and how wi dey bihave with una, dey show sey na God send us thru en pawa, nor bi human being own.


Make una test unasef to know weda una still dey inside di faith; e good make una shek unasef well-well! Una nor know sey Christ dey inside una? May bi una don fail di test!


Pipol wey sekonsaiz nor dey obey di law, but dem wont make una sekonsaiz, so dat dem go fit use una take boast.


So wen I kom meet una again as una dey serve Christ, una go get more rizin to dey happy bikos of mi.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ