Galatians 6:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
1 My brodas and sistas, if una si pesin dey sin, make una wey dey spiritual, koll am back. But make una wosh unasef, so dat una nor go fall inside temptashon too.
One day, David wake-up from sleep for aftanoon kon waka go di roof. As e dey waka round for der, e si one woman wey dey baf for en house and e fine well-well.
Make pipol wey dey fear God beat and korrect mi with love! Make my head nor rijet good oil! True-true, even with all dia wiked plans, my prayers dey make dem fear.
“Doz wey don lost and wey waka anyhow, I go find and bring dem kom back. Doz wey get sore, I go bandage am for dem kon heal doz wey dey sick; but doz wey fat and strong, I go distroy dem, bikos I bi shepad wey dey do wetin dey rite.
My brodas and sistas, wen I dey with una before, una dey bihave like pipol for dis world. Na dis make mi nor fit tok to una as pipol wey get God Spirit. Dat time, una faith for Christ bi like small pikin own.
Make una nor refuse each oda, escept una gri sey una go dey like dat for sometaim, so dat una go fit pray. Den Satan nor go fit tempt una, bikos una go fit kontrol una body.
Finally, my brodas and sistas, wi dey ask and beg una bikos of Christ sey, as una don hear from us about how una suppose live as God wont (as una dey do naw), make una kontinue to dey live like dat.
If anybody si en broda or sista for Christ dey kommit sin wey nor go kill-am, make e ask God and God go give life to dat pesin. E get di kind sin wey dey kause deat and I nor sey make una pray make God forgive di pesin wey dey kommit dat kind sin.