Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Galatians 5:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 Before, una dey do well; but naw, who sey make una nor obey di trut?

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Galatians 5:7
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

but di seed nor get rut, bikos di word wey e hear, nor strong for en heart, so wen trobol kom, e nor go fit bear-am.


Na so God word start to spread and di disciples wey dey Jerusalem kon plenty well-well. And many priests kon bilive Jesus Christ.


But nor bi evribody gri asept di Good News, even Profet Isaya sey, “My God, anybody don bilive awa message?”


With betta mind, evritin wey I dey tok about, na how Christ let mi tok and work, so dat Gentile pipol go obey am.


but naw, dem don tok am at last. God wey nor dey die, kommand en profets make dem rite about di Good News, so dat pipol for evriwhere, go obey am and get faith.


But E go show en vexnashon and ponish doz wey bikos of long-trot rijet di trut kon dey do bad tins.


But wi tank God sey, even doh una bi slave to sin before, una don use una heart dey obey all di tins wey wi dey tish una.


Una nor know sey, wen pipol dey run, na only one pesin go win di race and di prize? So make una run, so dat una go fit win!


pipol wey dey karry body up; doz wey nor wont make odas know God and as wi dey do like dis, pipol dey obey Christ.


I go der bikos of di revelashon wey I receive, den I tell dem about wetin I dey prish give Gentile pipol. But I tok with di oga dem, so dat dem go dey sure sey, I dey prish Christ message.


Galatia pipol, una nor get sense at-all! Who turn una to fool naw? Bikos na for una front wi for show sey Jesus Christ die for cross!


I get mind sey, God nor go let una listin to anoda pesin. But di pesin wey dey konfuse una, go face judgement, no matter who e bi.


Den Christ go use fire wey nor dey kwensh take ponish doz wey nor know God and wey nor dey obey wetin wi dey prish about am.


Na faith make Abraham obey wen God koll am make e leave en house, travel go anoda land wey God promise am, even doh e nor know where e dey go.


Since wi get many witness wey surround us, e good make wi drop evry load and sin wey dey make us fall, so dat wi go use awa mind live di life wey God wont.


Wen God don make Christ pafet finish, e kon save evribody wey obey am.


Una don klean una soul with di trut wey una dey obey and as brodas and sistas, make una love each oda well-well.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ