Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Galatians 5:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 And I dey warn evribody; anybody wey gri make dem sekonsaiz am, must obey evry oda tin wey di law tok.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Galatians 5:3
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Awa grand-grand papa dem, awa kings, leaders and priests nor keep yor law at-all. Dem nor listin to yor kommands and laws.


“E go bad for una, leaders wey blind, una sey, ‘Anybody wey take di temple swear, nor-tin go do am. But if e take di gold for Temple swear, curse go dey for en head.’


Una dey tish sey, ‘Anybody wey take di altar swear, nor-tin go do am, but if pesin take wetin dey for di altar swear, e must do wetin e tok.’


(bikos I get five brodas), so dat e go warn dem, make dem nor for kom sofa for dis place.’


Some men kom from Judea kon dey tish di brodas sey, “Unless dem sekonsaiz una di way Moses tok for di law, una nor go fit get salvashon.”


As Pita dey tok to di pipol, e kon warn dem, “Make una save una head from di ponishment wey dey kom meet wiked pipol.”


I dey prish give Jew and Greek pipol sey make dem turn from sin kom meet and serve God and put dia faith for awa Oga God Jesus Christ.


Sekonsishon get value only if yu dey do wetin di law tok, but if yu nor dey obey di law, yu and di pesin wey dem neva sekonsaiz na di same.


Pipol wey dey under di law and dem nor dey do evritin wey di law tok, dey under curse, bikos dem rite am sey, “E nor go betta for anybody wey nor dey do evritin wey dey di law.”


Una dey hear so! Mi wey bi Paul dey tell una sey, if dem sekonsaiz una, den Christ nor mean anytin to una again.


For Christ, e nor matter weda dem sekonsaiz pesin or not; di only tin wey matter, na faith wey dey work thru love.


So, I dey use Christ pawa take tell una dis tins sey, make una nor live una life like Gentile pipol wey dey tink only bad and tins wey nor get sense.


Anybody wey nor gri obey or keep dis law and kommand, na curse go follow am. Den all di pipol go ansa, “Amen.” ’ ”


Den wen wahala and sofa fall for dia head, dis song go bi witness against dem, bikos dia shidren-shidren nor go forget am. I know wetin dem dey tink for dia mind today, even before I take dem go di land wey I promise dem.”


But if una forget di Oga una God for evritin kon dey follow oda gods, dey woship and bow for dem, I go tell una today sey, God go really distroy una.


Make nobody shit en Christian broda or make am vex, bikos na God go fight for di pesin wey yu shit and wi don tell una before and wi still dey warn una sey, God go really ponish pipol wey dey do like dat.


Wi don si with awa eye sey, di Papa send en Pikin to bi Savior for di world.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ