But wen dem invite yu, make yu sidan for back chair, so dat wen di pesin wey dey do di party si yu, e go sey, ‘My friend, kom sidan for dis betta place for front.’ Den all di pipol wey dey follow yu chop, go give yu respet.
Filippi pipol, una know sey, wen I komot from Masidonia, for di time wen I just start to prish di gospel, na una bi di only church wey help mi and na only una dey follow mi share for my happiness and sofa.
For di same way, make una wey yong put body down for di eldas. Make una nor dey karry body up for each oda, bikos God dey oppoz proud pipol, but E dey favor doz wey dey honbol.