2 Una dey hear so! Mi wey bi Paul dey tell una sey, if dem sekonsaiz una, den Christ nor mean anytin to una again.
Some men kom from Judea kon dey tish di brodas sey, “Unless dem sekonsaiz una di way Moses tok for di law, una nor go fit get salvashon.”
Wi hear sey some pipol kom meet una sey dem kom from us, even doh wi nor send dem. Dem dey konfuse and tell una wetin go disturb una mind.
But some Farisee wey don bilive Christ stand up kon sey, “E good make wi tell Gentile pipol make dem sekonsaiz and do evritin wey Moses Law tok.”
Na mi Paul, rite dis leta with my own hand.
Naw, mi Paul (I kwayet wen I dey with una, but my mout dey sharp naw wen I don leave una). Christ wey nor dey karry body up, wey dey gentol,
Naw, my brodas and sistas, if I still dey prish about how dem go take sekonsaiz una, why pipol dey trobol mi? If na so, my tishing about Christ cross nor suppose kause any trobol.
For Christ, e nor matter weda dem sekonsaiz pesin or not; di only tin wey matter, na faith wey dey work thru love.
Wi bin won kom si una (mi wey bi Paul don try to kom many times), but Satan spoil awa plan.
Na mi Paul take my hand rite dis leta sey, I go pay back, but I fit still sey, yu yorsef dey whole mi.
mi Paul, wey bi old man and prisona bikos of Christ, won advise yu with love.
Bikos dem prish God word give us, just as dem prish am give dem too. But dem nor take am sirious, bikos wen dem hear am, dem nor gri bilive am.