bikos una neva get di Spirit since jealousy and kworel still dey among una. Dis mean sey una neva get di Spirit and una still dey live like pipol wey dey di world.
Bikos I dey fear sey wen I kom, I nor go like wetin I go si and una nor go like as I go tok. I dey fear sey una go dey kworel, dey jealous each oda; dey vex; dey tink of only unasef; dey tok bad about each oda; dey do aproko; dey karry body up and dey bihave anyhow.
Make una take kare and nor let anybody fool una with wayo tok about human being wisdom and spiritual pawas wey dey rule di world, but make una dey do as Christ wont.
Abimelek and en group, attack kon block di road wey dem dey pass enter di town. Den di remainin two group kon attack and kill di pipol wey dey for di field.