Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Galatians 4:8 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

8 Before-before, wen una nor know God, una dey do bad-bad tins.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Galatians 4:8
31 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Shebi yu porshu Levi pipol and God priest wey bi Aaron shidren-shidren? Yu put doz wey nor suppose bi priest for dia place, just as oda nashons dey do. Anybody wey kom with seven melu or seven ram fit bi priest for dat fake juju wey yu koll god.


But Fero ask dem, “Who bi dis God wey go make mi fear am kon let Israel pipol go? I nor know am, so I nor go let Israel pipol go.”


e burn all dia gods wey nor bi god at-all, bikos dem bi image wey human being use dia hands make.


Make Yu vex well-well for di nashons wey nor gri woship Yu and doz wey rijet Yu, bikos dem don kill and distroy yor pipol finish kon turn awa land to desert.”


Pipol fit make dia own gods? No! Wetin dem make, nor bi god at-all.”


No oda nashon don ever shange dia god, even wen dem know sey dia gods nor bi god at-all. But my pipol don shange mi God wey give dem honor, with gods wey nor go fit help dem.


God ask, “Jerusalem pipol! Wetin nor go make mi ponish una wen e bi sey, una leave mi kon go woship gods wey nor bi god at-all? Even doh I dey give una evritin wey una wont, una still dey bihave like wife wey go sleep with who nor bi en husband and una dey stay with ashawo.


E kom inside di world wey e make my ensef, but di pipol nor know am.


Dem start to koll Banabas, “Zeus” and Paul, “Hermes”, bikos na Paul dey lead dem.


Bikos as I waka round dey look all di tins wey una dey woship, I even si one shrine wey dem rite put sey: ‘To di god wey pipol nor know.’ So wetin una dey woship wey una nor know, naim I kon tell una about today.


bikos instead make dem woship God wey dey heaven, dem kon dey woship image wey dem mold or karve like pesin, bird, animal or snake.


Since dem nor gri put God for mind and serve am, E kon leave dem make dem use dia bad mind dey do tins wey dem nor suppose do.


God wise well-well, so E nor let pipol for dis world know am with di wisdom wey dem get. Instead, E save only di pipol wey bilive di foolish message wey wi dey prish.


I won make una remember sey, before una bigin follow Christ; na juju una dey serve.


So, even if pipol dey offa food give juju, all of us know sey di juju dem nor get life, bikos na only one God dey.


Na so e bi with us wen wi small; wi dey under di pawa wey dey kontrol dis world,


Dia mind dey for darkness and dem nor get part for di life wey God dey give, bikos dem sturbon and nor fit undastand.


Pipol dey tok about how una welkom us and leave di juju wey una dey serve before kon follow di true God wey get life.


nor bi to dey follow who yu nor marry, just as Gentile pipol wey nor know God dey do.


Den Christ go use fire wey nor dey kwensh take ponish doz wey nor know God and wey nor dey obey wetin wi dey prish about am.


If una sey una nor won woship God, den today-today, make una choose who una go woship, weda na una grand-grand papa gods wey dey di oda side for di river, or Amor pipol gods wey dey di land wey una dey stay so. But for mi and my whole house, na di Oga awa God wi go woship and serve till wi die!”


Joshua tell di pipol, “Dis na wetin di Oga wey bi Israel God tok: ‘Before-before, una grand-grand papa dey stay afta Eufrates River, plus Terah wey bi Abraham and Nahor papa. Dem woship anoda god,


Di time wey una dey bihave like unbilivers, don pass. Dat time una live bad life; dey do bad tins; dey drink; dey do anyhow and serve juju.


Make una si di kind love wey awa God get for us. And naw, pipol dey koll us God shidren and true-true, na God shidren wi bi. Di world nor know us, bikos dem nor know am.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ