God sey, “I go take una back as my shidren kon give una betta land; di land wey fine pass for di whole world. Den una go koll mi, ‘Papa’ and una nor go turn from mi again.
I tell una true word, na for una own good naim make mi won go, bikos if I nor go, di Pesin wey go help una nor go kom, but if I go, I go send am kom meet una.
(E tok dis tin about di Spirit wey di pipol wey bilive am go get, bikos by dis time, God neva give en Spirit to pipol, bikos E neva honor Jesus Christ.)
Di first man na Adam and God word sey, “Dis Adam na pesin wey God kreate like us. But Jesus, wey bi di last Adam, na pesin wey dey give life to pipol.”
Make una nor do wetin go make di Holy Spirit vex. Bikos na di Holy Spirit bi di mark wey God put for una body, so dat for judgement day, E go know doz wey E go save.
With difren prayers, make una dey ask God to help una. Make una always dey pray with di Spirit and dey shine una eyes well-well. Make una nor give up, but make una kontinue to pray for all God pipol.
So, I kon bow make I for woship di angel, but e sey, “Nor do dis tin! I bi savant and broda like yu wey whole di trut about Jesus well. Make yu woship only God, bikos na di profesy spirit bi di true word about Christ.”