Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Galatians 4:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 Na so e bi with us wen wi small; wi dey under di pawa wey dey kontrol dis world,

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Galatians 4:3
20 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Una wey don taya and karry heavy load, make una kom meet mi and I go give una rest.


Jesus kon tell di pipol wey kom from Judea wey bilive am, “If una obey wetin I dey tish una, den una go bi my disciples


So why una won kon try God? Load wey wi and awa grand-grand papa dem nor fit karry, why una dey put am for dis disciples head?


Wi know sey di law dey spiritual. But I bi human being and dem don sell mi give sin.


Di Spirit wey God give us nor go make us fear like slave, instead, wi bi God shidren and wi dey koll am, “Awa Papa!”


Una like make pesin turn una to slave; use and shit una; take evritin wey una get, den beat and slap una anyhow.


Dem diskuss dis matter, bikos of di fake brodas with dia wayo wey dem take dey spy di freedom wey Christ give us, so dat dem go fit make us dia slave.


Na awa sin make law dey and na so e go bi, until di pikin wey God promise, go kom and na thru angels, God take give us di law thru en profet.


But e go dey under who dey guide am, until di time wey en papa tok, go rish.


Betta sense dey for dis story, bikos dis two wimen bi like two kovenant. One na from Mount Sinai wey bi like di shidren wey Hagar, di slave woman, born.


Hagar bi like Mount Sinai for Arabia kountry and na di same with Jerusalem wey dey naw, bikos e dey inside der as slave with en pikin.


So my brodas and sistas, wi nor bi savant shidren. Na di really woman shidren, wi bi.


Before-before, wen una nor know God, una dey do bad-bad tins.


But naw wey una don know am (or abi make I sey God don know una), why una still dey follow all dis weak and yeye pawas? Una won bi dia slave again?


Since una don die with Christ and e don free una from wiked pipol, den why una still dey bihave as pipol wey nor know God?


Make una take kare and nor let anybody fool una with wayo tok about human being wisdom and spiritual pawas wey dey rule di world, but make una dey do as Christ wont.


E don tey wen una bi Christian, so by naw, una suppose to dey tish odas. Instead, una still wont make pesin kom tish una di first tin wey dey God word. Una still dey drink milk, instead of una to dey chop solid food.


E nor selet dat pesin bikos of en grand-grand papa dem, but na bikos en life nor go ever end.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ