29 For dat time, di one wey dem born for normal way, trobol di one wey dem born with di Spirit and na so e bi with una naw.
But one day, di pikin wey Hagar, Sarah savant wey kom from Egypt, born for Abraham kon dey laf Isaak and Sarah kon si dem,
“As my Papa love mi, na so I love una too, so make una live di kind life wey go let mi fit love una more-more.
Jesus ansa am, “I tell yu di trut, unless God born pesin with wota and en Spirit, di pesin nor go fit enter God kingdom.
So, God nor go kondemn pipol wey bilive Jesus Christ.
Bikos if una dey follow sin, una go die. But di Spirit pawa go kill all di bad tins wey una dey do, so dat una go get life.
Di one wey savant born, na ordinary pikin e bi, but na thru God promise di really wife take born.
Naw, my brodas and sistas, if I still dey prish about how dem go take sekonsaiz una, why pipol dey trobol mi? If na so, my tishing about Christ cross nor suppose kause any trobol.