22 Dem rite am sey, Abraham get two boys, one wey di savant woman born and di oda pikin, na di really wife born am.
So Hagar born boy for Abram and en name na Ishmael.
so e tell Abraham, “Make yu porshu dis slave and en pikin, bikos di slave pikin nor go fit follow my pikin share for di propaty!”
Di one wey savant born, na ordinary pikin e bi, but na thru God promise di really wife take born.
But wetin dem rite for God word? “Make yu drive di savant woman and en pikin komot, bikos di savant pikin nor go share with di pikin wey di really wife born.”
So my brodas and sistas, wi nor bi savant shidren. Na di really woman shidren, wi bi.