20 How I wish sey I dey with una naw, so dat I go know how to trit una, bikos I dey worry about una well-well.
Herod dey fear John well-well, so e dey protet am, bikos e know sey John na holy man wey dey do wetin God like. Anytime Herod hear John dey prish, en mind go dey worry am, but e still dey like to listin to am.
Wi dey face wahala for difren korna, but awa body nor skata; wi dey konfuse sometaim, but wi nor dey luz hope,
and wi dey tank God for una. Wi dey tank am for di joy wey wi get for en present bikos of una.