Dem hear sey yu dey tish Jew pipol wey dey stay with Gentile pipol, sey make dem trowey Moses Law; make dem nor sekonsaiz dia shidren again and make dem nor follow awa laws again.
But wen I si sey dem nor dey do wetin dem rite for God word, I kon tell Pita for dia front, “If yu wey bi Jew, dey do like Gentile pipol, how yu wont take make Gentile pipol live like Jew pipol?”
I nor go boast about anytin escept for di sofa wey awa Oga God Jesus Christ sofa and bikos of dat sofa, di world nor mean anytin to mi and I don die to di world too.