So I ansa, “I don work well-well, yet my work nor mean anytin! I use all my pawa, but I nor gain anytin.” But I still bilive sey, God go defend and reward mi for evritin wey I don do.
So my friends, make una dey strong and nor let anytin shake una. Make una always dey do God work, bikos una know sey, evritin wey una do for God, get gain.
I go der bikos of di revelashon wey I receive, den I tell dem about wetin I dey prish give Gentile pipol. But I tok with di oga dem, so dat dem go dey sure sey, I dey prish Christ message.
So wen I nor fit bear again, I send pesin make e help mi shek how una faith bi, bikos I dey fear sey devil wey dey tempt pipol, don tempt una and all di work wey wi do among una, don dey yuzles.