7 na so too, doz wey bilive, go bi Abraham shidren.
Make una know sey na di Oga God bi God! Na-im make us and wi bi en pipol. Wi bi en pipol, di sheep wey dey en field.
Den Jesus sey, “Salvashon don kom dis house today, bikos dis man na Abraham pikin too.
Na so una go still know too, wen una si all dis tins dey happen, una go know sey God Kingdom don near.
Dem tell am, “Na Abraham bi awa papa.” Den Jesus ansa dem, “If una bi Abraham pikin, una for dey do di tins wey Abraham do.
No! E tok am for wi too wey God go still asept as raitious pipol; wi wey bilive sey God raiz Jesus Christ from deat.
So pipol wey bilive, God go bless dem togeda with Abraham, bikos dem bilive.
Una wey dey obey dis rule wey I dey give so, make peace and mesi dey with una and all God pipol.
Make una know sey dem don release awa broda Timoti from prison. If e kwik kom, e go follow mi kom si una.