Jesus ansa am, “Make yu neva tosh mi, bikos I neva go meet my Papa for heaven. Go meet my brodas, tell dem sey, ‘I dey go heaven go meet my Papa, wey bi yor Papa too; my God, wey bi yor God too.’ ”
Paul, wey bi Jesus Christ apostle, bikos na so God wont am, naim and Timoti awa broda, rite dis leta go give God pipol for di church wey dey Korint and to all di good brodas for Akaia.
Dis leta na from Paul, wey bi Jesus Christ apostle, bikos na so God wont am. I dey rite to God pipol wey dey for Efesus, di ones wey dey follow Jesus Christ with faith.
so dat una nor go get any blame and una go dey klean. God Pikin nor get fault; even doh una dey live for di world wey bad pipol dey, una go dey shine like stars,