So my brodas and sistas, na so e bi with una too. Una don bikom part for Jesus Christ body and una don die to di law pawa. Naw, una dey free to bi Christ own; di pesin wey God raiz from deat make una for dey serve am.
Bikos even if 10,000 pipol kon tish una about Christ, na only one papa una go still get. Bikos una don turn to my pikin, wen una receive di message about Christ from mi.