Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Galatians 3:21 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

21 So di law dey against God promise? No! Bikos if di law dey give pesin life, den raitiousness go must kom thru di law.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Galatians 3:21
18 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

E go kom distroy all dis tenant, den give di grape farm to new tenants.” Wen di pipol hear dis, dem kon sey, “Make dis tin nor happen o-o!”


So make wi trowey di law bikos of faith? No way! E nor go work! Instead, wi go make di law strong well-well.


Even doh evry human being dey lie, God nor fit lie. God word sey: “Make yu dey tok wetin bi trut; so dat yu go fit win yor kase wen dem dey judge yu.”


Wi nor fit tok so at-all! If God nor dey rite, na how E go kon take judge di world?


And Israel pipol wey dey try to do wetin God wont, nor fit do am.


Di ministry wey dem rite for slate bring deat kom and di glory wey follow am, nor let Israel pipol fit look Moses face. If di glory wey dey Moses face, fade bikos e dey under di law,


Make wi dey kommit sin as wi dey try to do good, bikos wi get faith for Christ? If na so, dat mean sey Christ don dey support sin!


As for di law, I don die to am, so dat I go fit dey alive with God.


I nor go trowey God grace; bikos if na wetin di law tok go make pesin good, den Christ die for nor-tin!


I nor go boast about anytin escept for di sofa wey awa Oga God Jesus Christ sofa and bikos of dat sofa, di world nor mean anytin to mi and I don die to di world too.


Na faith make Noah build ark afta God warn am about wetin go happen. E obey wetin God tok and na di ark save en and en family. Na di same faith Noah take kondemn di world, kon inherit di raitiousness wey dey kom.


Bikos of dis, God put di old law for korna, since e dey weak and yuzles,


bikos di law nor fit make anytin dey pafet. But naw, wi get betta hope wey go draw us near God.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ