Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Galatians 2:21 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

21 I nor go trowey God grace; bikos if na wetin di law tok go make pesin good, den Christ die for nor-tin!

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Galatians 2:21
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

God skata di nashons plan kon spoil wetin dem won do.


So I ansa, “I don work well-well, yet my work nor mean anytin! I use all my pawa, but I nor gain anytin.” But I still bilive sey, God go defend and reward mi for evritin wey I don do.


How una go sey, ‘Wi wise well-well and wi know God law, wen e bi sey, doz wey dey tish di law, don shange wetin e really mean?’


Jesus still tell dem, “Una rijet God kommandment, so dat una go fit keep una own.


as e bi sey dem nor know how God dey take make pipol good, instead, dem dey try to make demsef good by dia own pawa, since dem nor gri do wetin God wont.


If na by grace God choose dem, dat mean sey, nor bi by pesin pawa: Bikos if na by pesin pawa, den grace nor mean anytin again.


Na awa sins make God give Jesus Christ to dem make dem kill-am and God raiz am from deat, so dat e go make us raitious pipol.


Wetin wi go tok about all dis tins? If God dey for awa side, who go fit dey against us?


And if Christ nor raiz-up, den awa prishin and una faith nor mean anytin.


If God nor raiz Christ from deat, den una faith dey yuzles and una still dey inside una sin.


di one wey una asept and dey stand on. Na dis gospel go save una if una whole di message wey I prish give una well-well, unless una faith nor strong.


Wi know sey nobody dey free from God judgement, bikos na so di law tok and pipol go only dey free, if dem get faith for Christ. Since wi don bilive Christ, wi suppose to dey do good thru di faith wey wi get for Christ and nor bi to dey do wetin di law tok and wi nor go dey free from judgement, wen wi do only wetin di law tok.


Naw, if I dey ripair di law wey I don first skata, dat mean sey I dey break God law.


So di law dey against God promise? No! Bikos if di law dey give pesin life, den raitiousness go must kom thru di law.


Even doh Moses Law sey priest must kom from Levi family, dat kind priest nor fit make pesin dey pafet. So anoda priest like Melkizedek must kom and e nor bi like priest wey kom from Aaron family.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ