Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Galatians 2:15 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

15 Wi bi Jew pipol bikos of how dem born us and wi nor bi Gentile pipol wey bi sinnas.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Galatians 2:15
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Wen di Farisee si wetin dey happen, dem kon bigin ask di disciples, “Wetin make una tisha dey follow tax kollectors and sinnas dey chop?”


‘Dem must sell Man Pikin give wiked pipol and dem go kill-am trowey and for di third day, e go wake-up.’ ”


But di Oga God sey, ‘Go, bikos I go send yu go far-far go meet Gentile pipol.’ ”


So wetin wi go tok? Wi go sey na wi wey bi Jew betta pass? Dat na lie! Bikos as I don already show una, Jew and Gentile pipol dey kommit sin.


Na dis one make God promise dey kom by faith and wi dey get am thru favor. Nor bi only pipol wey dey obey di law bi Abraham shidren, but pipol wey bilive God like Abraham, naim en shidren dem bi too, bikos na Abraham bi awa spiritual papa.


Make wi dey kommit sin as wi dey try to do good, bikos wi get faith for Christ? If na so, dat mean sey Christ don dey support sin!


All of us dey live dis kind life before. Wi dey do difren tins wey awa body and mind wont. Dat time, wi bi shidren wey God won ponish like oda sinnas.


Aldo my own rizin important too. If anybody tink sey e get betta rizin to put hope for wetin human being dey do, mi Paul, get pass dem.


Before naw, wi dey bihave like fool; wi nor dey obey; wi dey deceive pipol; wi bi savant to tins wey dey sweet us; wi dey do bad tins and dey jealous odas; pipol hate us and wi hate dem too.


God send and tell yu sey, ‘Go kill all doz wiked Amalek pipol! Fight dem until yu don distroy all of dem.’


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ