2 Mi and di brodas wey dey here, dey greet una wey dey Galatia.
Paul pass thru Siria and Silisia dey enkourage di pipol wey dey di church dem for der.
Afta e don stay small for der, Paul komot kon travel pass all di aria wey dey Galatian and Frigia, dey enkourage all di disciples.
Dat time, di church wey dey Judea, Galilee and Samaria get rest and dis kon make dem strong as dem dey stay togeda, dey woship God with all dia heart and as di Holy Spirit dey tok to dem. So pipol wey dey di church kon dey plenty more-more.
Wen una kollect money from God pipol, I wont make una do as I tell di pipol wey dey di church for Galatia sey make dem do.
Galatia pipol, una nor get sense at-all! Who turn una to fool naw? Bikos na for una front wi for show sey Jesus Christ die for cross!
Una know how mi and Timoti bi, sey as pikin dey work with en papa, na so e dey follow mi work, so dat di gospel go stand.
Make una greet God pipol wey dey for Christ.