Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Galatians 1:14 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

14 I grow among Jew pipol kon know di relijon pass many of my mates for my kountry and I know my grand-grand papa dem tradishons.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Galatians 1:14
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

God sey, “Dis pipol sey dem dey obey mi, dem dey tok good-good tins about mi, but dem nor really dey respet mi and evritin wey dem tok nor rish dia heart. Dia relijon na law and tradishon wey human being make with dia own hand.


Una tink sey wetin una dey do dey rite, but I go disgrace una and una juju nor go fit help una.


If dem ask yu, ‘Where wi won go?’ Tell dem sey, ‘God sey: “ ‘ “Pipol wey dem don sey, na diziz go kill, na diziz go really kill dem. Doz wey dem sey go die for war, go really die for war. Doz wey dem sey na honga go kill, na honga go kill dem and doz wey dem sey dem go katch go as slave, dem go katch dem go.” ’


Instead, dem get strong heart kon dey woship Baal, just as dia grand-grand papa tish dem.


But wen di sore don heal and e don turn white back, di pesin go-go meet di priest,


den e nor nid to respet en papa again.’ Bikos of una tradishon, una don make God word yeye.


Wen dem hear wetin e tok, dem kon dey praiz God. Den, dem tell am, “Yu si, awa broda, many Jew don bilive and dem still dey obey di law!


“I bi Jew wey dem born for Tarsus wey dey Silisia, but na for dis town I for grow, I go skool and learn awa grand-grand papa dem law well-well under Gamaliel and I get mind to serve God well-well, just as una bi today.


Since dem know mi, if dem go gri kon tok, dem go gri sey na how wi dey serve God, naim I take live as Farisee.


Even mi mysef, I bilive before sey make wi fight Jesus Christ wey kom from Nazaret.


Make una take kare and nor let anybody fool una with wayo tok about human being wisdom and spiritual pawas wey dey rule di world, but make una dey do as Christ wont.


Aldo una neva si am, but una love am. Una nor dey si am naw, but una bilive am, una get happiness and glory wey una nor go fit esplain.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ