11 My brodas and sistas, I wont make una know sey di gospel wey I dey prish, nor bi human being give mi.
So just as I prish give una, na so e go bi for dat day, wen God go judge all di sekret tins wey dey pipol heart thru Jesus Christ wey bi en pikin.
I don already tell una wetin awa Oga God Jesus do for di nite wen dem sell am. And na Christ tok am by ensef. E take some bread for en hand
Some of una dey sey, “Na Paul I dey follow,” odas sey, “Na Apollos bi awa leader.” Na pipol wey nor know God dey do like dat!
Una tink sey na only kommon sense I take dey tok all dis tins? Abi una don forget sey di law tok like dis too?
Na mi Paul, rite dis leta, (nor bi human being make mi apostle, but na Jesus Christ and God awa Papa wey raiz am from deat).
I sopraiz sey una kwik turn back from di Pesin wey koll una with en grace kon bigin follow oda tishing.