Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Filippians 4:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 E get sometaim wey I nor get and sometaim, I dey get plenty. But for evry kondishon, I don learn how to dey okay, weda my belle full or I dey hongry; weda I get plenty or I nor get anytin at-all.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Filippians 4:12
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Yu send yor good Spirit make e tell dem wetin dem go do and Yu nor stop to give dem manna chop and wota to drink.


True-true, dis na wetin God tok. E hold mi kon warn mi sey make I nor bihave like dis pipol:


Before, wi sin against Yu, but naw, wi wons turn from sin kom meet Yu. Afta Yu ponish us, shame nor let us karry awa head up again. Di sin wey wi sin wen wi dey yong, dey make us dey shame.”


Make una follow mi and learn from mi, bikos I gentol, I nor dey karry body up and I go give una peace for una mind.


Den Jesus kom tell dem, “Anybody wey dey tisha di law and e bi disciple for God Kingdom, go bi like pesin wey get house kon bring new and old tins kom out from inside di house.”


Naw, mi Paul (I kwayet wen I dey with una, but my mout dey sharp naw wen I don leave una). Christ wey nor dey karry body up, wey dey gentol,


bikos some pipol dey sey, “En letas dey heavy and get pawa well-well, but if yu si am for groun, e nor get pawa and e nor even fit tok well.”


I don do hard work; nor sleep for many nites; food and wota go dey hongry mi; many times, I nor get food to chop. I don dey for kold and I nor get klot to kover body.


As I honbol mysef dey do di work, na sin I kommit? I dey do am, so dat una go fit grow up and wen I prish give una, I nor kollect money.


Wen I nid anytin for di time wen I dey with una, I nor put my load for anybody head, bikos awa brodas wey Masidonia dey give mi evritin wey I nid. I nor allow mysef to bi problem for anybody and I nor go ever do am.


Na empty dirty land for wildaness E for si dem. E dey look and guide dem for evry korna; E dey guide dem as pipol wey E love well-well.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ