Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Filippians 3:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 Dem sekonsaiz mi eight days afta dem born mi. I kom from Israel, Benjamin tribe and I bi Hibru man. I bin dey live akordin to di law, bikos I bi Farisee.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Filippians 3:5
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

One pesin kon run go tell Abram wey bi Hibru. For dis time, Abram dey stay near Mamre wey bi Amor pipol oak. Dis Mamre na Eshkol and Aner broda. (All dis group don join Abram.)


plus yor savant wey bi strenja shidren wey dem go born for here. Dis go show sey mi and yu, get kovenant.


Bikos dem buy mi kom from Hibru land and for der, I nor do anytin wey make dem put mi for gutta.”


Naw e get one yong Hibru man for der and e bi di guide oga savant. Wi tell am wetin wi dream and e tell di two of us wetin awa difren dreams mean.


Jonah ansa, “I bi Hibru pesin! I dey woship God; di Pesin wey make heaven, land and sea.”


Wen di pikin rish eight days, dem sekonsaiz am, won kon gi-am en papa name, Zekaraya.


Wen di pikin rish eight days, dem sekonsaiz am kon koll am, “Jesus”, di name wey di angel tok before en mama even get belle.


Instead, pipol suppose pour new wine inside new wine bag.


“I bi Jew wey dem born for Tarsus wey dey Silisia, but na for dis town I for grow, I go skool and learn awa grand-grand papa dem law well-well under Gamaliel and I get mind to serve God well-well, just as una bi today.


Den wen Paul know sey some pipol wey dey der na Sadusi and odas na Farisees, e kon shaut make di whole kansol hear, “My brodas, I bi Farisee, na Farisee pesin born mi. Dem dey judge mi today, bikos I put hope sey pipol wey don die go wake again!”


As time dey go, wen di disciples don plenty, di Jew pipol wey dey tok with Greek language kon dey kworel with di oda kountry-men wey dey tok Hibru. Dem kon dey komplain sey, “Wen dem dey share food, di Hibru men dey sofa wimen wey dia husband don die.”


I dey ask, God don rijet Israel, en pipol? No! Mi too, na Israel pesin, I bi Abraham pikin wey kom from Benjamin tribe.


Na Hibru pipol dem bi? Misef na Hibru pesin too. Dem bi Israel pipol? Mi na Israel pesin too. Na Abraham bi dia grand-grand papa? Na dat same Abraham bi my grand-grand papa too.


Wen Filistia pipol hear di pipol shaut, dem kon sey, “Wetin make Israel pipol dey shaut like dis for Hibru kamp?”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ