Filippians 3:19 - Holy Bible Nigerian Pidgin English19 Dem go end for hell; na dia belle bi di god wey dem dey serve. Tins wey suppose make dem shame, naim dey make dem happy and na only tins for dis world dem dey tink about. အခန်းကိုကြည့်ပါ။ |
Instead, wi go do evritin wey won do. Wi go offa sakrifice give awa goddes wey bi Heaven Kween kon pour wine for am too, just as wi, awa grand-grand papa, awa king and leaders dey do for Judah towns and Jerusalem strits before. Dat time, wi get plenty food to chop; wi dey prosper and wi nor get wahala.
But for pipol wey fear nor dey let dem do wetin good; doz wey nor bilive mi, doz wey nor dey obey mi; doz wey kill odas; pipol wey dey sleep with who dem nor marry; doz wey dey do majik; pipol wey dey serve juju and evribody wey dey tok lie, na inside di fire and sulfur dem go-go. And na dat bi di sekond deat.”