Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Filippians 3:15 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

15 So wi wey don mature for Christ, make wi get dis kind mind. But if una dey tink difren tins, I bilive sey God go show una di trut.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Filippians 3:15
21 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

One fine road go dey der and dem go koll am, “Holiness Road.” No sina go travel pass dat road and foolish pipol nor go fit deceive doz wey dey waka pass der.


So make una dey pafet as una Papa wey dey for heaven, pafet.”


Since una fit give una pikin good tins as una bad rish, wot of una Papa for Heaven wey go give di Holy Spirit to anybody wey ask am?”


Na so di profets rite sey, ‘God go tish evribody.’ Anybody wey hear wetin my Papa tok, go kom meet mi.


Anybody wey ready to do wetin God wont, di pesin go know weda wetin I dey tish na from God or na my own.


If awa faith dey strong, den make wi dey patient with doz wey get weak faith. Make wi try to make dem happy, instead of awasef.


My brodas and sistas, make una stop to tink like small shidren. Instead make una dey tink like mature pipol and dey innocent like pikin wey dem just born.


Wi dey tok with wisdom to doz wey really know God word, but nor bi with dis world or any ruler wisdom, bikos dia wisdom nor mean anytin.


I get mind sey, God nor go let una listin to anoda pesin. But di pesin wey dey konfuse una, go face judgement, no matter who e bi.


I pray make God, awa Oga God Jesus Christ Papa wey get glory, give una spiritual wisdom and revelashon, wey go make una know am well-well.


As wi dey tell evribody wetin dem go do, wi dey prish Christ and tish with wisdom, so dat wen wi go show una to Christ, una go don dey pafet.


Epafras, wey bi one among una and Christ savant, dey greet una. E dey pray well-well for una, so dat una leg go strong for groun and una go grow as una dey learn di tins wey God wont.


No nid to rite give una about love for una fellow Christians, bikos God ensef don tish una about how una suppose love each oda.


so dat as wi dey do God work, wi go fit do am well and wi go get evritin wey wi nid to take do good tins.


But solid food na for mature pipol and dem get betta sense to know wetin dey good and bad.


But anybody wey do wetin dem rite for God word, true-true, God word really dey inside am. Na dis go make us know sey wi dey inside God.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ