Na who big pass? Na di pesin wey sidan for tabol dey chop or di pesin wey dey serve am? Nor bi di one wey sidan for tabol? But I dey do like savant among una.
Jesus Christ wey kom from Nazaret, na-im God give di Holy Spirit and pawa. Una still know how e do good for evriwhere kon heal pipol wey devil dey opress, bikos God dey with am.
Like dis, I don show una sey wi must help pipol wey dey weak and una remember wetin Jesus Christ tok, wen e sey, ‘E betta make pesin dey give pipol tins, dan make e dey kollect from dem.’ ”
Bikos if di food wey yu chop make yor broda or sista vex for yu, den yu nor dey show love again. So make yu nor let di kind food wey yu dey chop, offend di pesin wey Jesus Christ die for.