Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Filippians 2:27 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

27 E sick well-well sotey e nearly die. But God get mesi for am; nor bi only for am, but for mi too, so dat I nor go kry join di one wey I dey so.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Filippians 2:27
23 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

For dat time, King Hezekaya kon dey sick and e nearly die. Amos pikin, Profet Isaya go si am kon sey, “God sey make yu arrange evritin as dem suppose dey, bikos yu nor go well again. Make yu ready to die.”


E go save yu from trobol six times and wen e rish di sevent one, evil pipol nor go fit tosh yu.


Pipol wey dey do wetin dey rite, dey face trobol well-well, but God go save dem from all dia wahala.


No, but God vex for en pipol kon send dem go Babilon as dia ponishment. E karry dem komot from dia land with one strong breeze from di east.


Di pain wey I go thru na for my own good. Yu save my life from all di wahala kon forgive mi my sins.


Wen una dey pass thru deep wota, I go dey with una. Una go fit handle any wahala wey kom una way. Wen una pass thru fire, e nor go burn una. Di temptashon wey go kom, nor go too hard for una.


Abeg God, make Yu korrect wi wey bi yor pipol. Make Yu nor ponish us bikos Yu dey vex, if not, all of us go die finish.


Yu sey, ‘I don taya and I nor get hope again! God don add join all my wahala and naw, my body dey pain mi and I nor get rest!’ ”


Den I sey, “Nobody fit cure my pain bikos my heart heavy well-well.


My God, I don hear evritin wey Yu do and e sopraiz mi well-well. Even naw for awa time, make Yu still do dat wonderful tin wey Yu do before. Even wen Yu dey vex, make Yu sorry for us.


E sick and e kon die. Wen di pipol don wosh en dead body, dem kon karry am put for one room for upstair.


E nor get anytin wey dey happen to una naw, wey neva happen to odas before, but God dey keep en promise and E nor go allow una pass thru wetin una nor go fit bear.


So make una forgive and help am, so dat e nor go luz hope and life nor go taya am.


True-true, e miss all of una well-well and en mind dey worry am, bikos una hear sey e nor well.


Na dis make mi won really send am kom meet una, so dat wen una si am, belle go sweet una again and I nor go dey worry about una.


bikos e nearly die bikos of Christ. E put en life for danger, so dat e go fit help mi do wetin una for do, since una nor dey here.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ