24 Aldo I bilive Christ sey, e nor go tey, before mi mysef go kom visit una.
As Jesus Christ wont am, I go send Timoti kom meet una, so dat my heart go strong small, with di news wey I go hear about una.
So, make yu prepare where I go stay, bikos I know sey yor prayers go make dem free mi kom meet yu soon.
Even doh I get many oda tins wey I won tell una, I nor won take paper and biro rite dem, but I hope sey I go kom visit una and I go tok to una face-to-face, so dat awa happiness go full.
I dey hope sey I go soon si yu and wi go tok face-to-face.