Na to enkourage una make mi send Timoti, my son wey I like and wey love Christ kom meet una. E go tell una how I dey follow Christ and di tins wey I dey prish about Christ for evry church.
So wi dey send awa broda follow dem; awa broda wey wi don test plenty times kon si sey e get di mind to help and e ready to help naw, bikos e trust una well-well.
So e dey good for mi to dey tink about una like dis, bikos una dey my heart. Una don follow mi share from God favor, even wen I dey prison and wen I dey prish di trut about di gospel.
Timoti my pikin, na as dem tok for di words wey dem profesai about yu before, na-im make mi give yu dis kommand. So make dis words make yu strong as yu dey fight for Christ.
If yu give all dis kommand to di brodas and sistas, yu go bi good savant for Christ, bikos yu don feed yorsef with God word, wey bi di spiritual food and naim bi di good tishing wey yu dey follow.