Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Filippians 2:21 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

21 Di odas dey busy with dia own matter, but nor bi matter wey koncern Christ.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Filippians 2:21
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

For di twenty-three years wen Jehoash don bi king, di priests neva still ripair where spoil for di Temple.


Dem bi like wiked dogs wey nor-tin dey satisfy. Dis leaders nor dey undastand at-all. All of dem dey do as dem like.


God sey, “I wish sey one of una go klose di temple door, so dat una nor go dey burn yuzles fire for my altar. I nor dey happy with una and I nor go asept di sakrifice wey una dey bring kom give mi.”


Den Jesus tell en disciples, “If anybody won follow mi, e must deny ensef, karry en cross and follow mi.


“If anybody kom meet mi and e nor love mi pass en papa, mama, wife, pikin, brodas and sistas, even en ownsef, e nor go fit bi my disciple.


Paul and di pipol wey follow am kon travel from Pafos go rish Perga wey dey for Pamfilia, but John Mark leave dem kon go back to Jerusalem.


but Paul sey make dem nor karry am, bikos na so e take leave dem for Pamfilia before and e nor follow dem do di work.


Make pesin nor dey tink for ensef alone, but for oda pipol too.


Make una dey do as I dey do; bikos I dey always try to please evribody instead of mysef, bikos I wont make God save dem.


or dey proud. Love nor get long-trot or dey vex. E nor dey remember di bad tins wey odas do.


Just as wi sofa with Christ, na so too wi go get help from God thru Christ.


Make una nor dey tink about unasef alone and wetin una wont, but make una dey tink about wetin good for odas too.


Yu know sey evribody for Asia, Figelus and Hermogenes aria, don run leave mi.


Pipol go dey tink of diasef alone; dey like money; dey boast; dey karry body up; dey tok bad about God; dey disobey dia papa and mama and dem nor dey tank even pipol wey do good for dem.


Bikos Demas love dis world tins, e kon run leave mi go Tesalonika. Crescens don go Galatia and Titus go Dalmatia.


Di first time wen dem karry mi go kourt, evribody abandon mi and all of dem run leave mi. Make God nor judge dem bikos of wetin dem do!


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ