20 Among all di pipol for here, na only Timoti get di kind mind wey I get for una and naim dey make mi tink of una and how una dey manage.
But na yu my klose friend; di pesin wey I like well-well.
En husband go sey, “Many wimen na good wifes to dia husband, but yu betta pass all of dem.”
Bikos di pesin nor kare for di sheep, go run leave dem.
(Judas tok like dis, nor bi sey e kare for poor pipol, but bikos na tif e bi. As e bi sey naim dey keep di money, e dey tif from am.)
So, I pray sey, God wey dey give konfort and patient, go help una live for peace with one anoda as una dey follow Jesus Christ,
Wen Timoti kom, make una nor make am fear at-all, bikos na God work wey I dey do, naim e dey do too.
Den, make una let my joy dey komplete, as una dey gri with each oda and dey love and work togeda with one mind.
Una know how mi and Timoti bi, sey as pikin dey work with en papa, na so e dey follow mi work, so dat di gospel go stand.
Jesus wey dem still dey koll Justus, dey greet una. Jew pipol wey bi Christian and dey follow mi do God work, na only dem dey help mi.
To Timoti, my own pikin for di faith. Make favor, mesi and peace wey dey kom from God awa papa and Jesus Christ awa Oga God, dey with yu.
If yu give all dis kommand to di brodas and sistas, yu go bi good savant for Christ, bikos yu don feed yorsef with God word, wey bi di spiritual food and naim bi di good tishing wey yu dey follow.
I always dey remember di faith wey yu first get from yor grand-mama, Lois and from yor mama, Eunice. I dey sure sey e dey inside yu.
But yu don know my tishings; di way I dey live my life and why I dey do wetin I dey do: my faith; patient; love and as I dey bear.
Wen David don tok to Saul finish, en and Jonatan kon turn tait friend. Jonatan like David as e like ensef.
Jonatan kon make kovenant with David, bikos e love am as e love en own life.