Many pipol and many Jew oga kon bilive Jesus, but bikos of di Farisee pipol, doz wey bilive nor fit tok for publik about Jesus Christ, so dat dem nor go drive dem komot for di sinagog.
Wen Jesus don tok all dis tins finish, e look heaven kon sey, “My Papa, di time don kom wen yu go give glory to yor pikin, so dat yor pikin go give yu glory too.
so dat evribody go bow down for di pikin as dem dey bow down for di Papa. If anybody nor bow show respet for di pikin, e nor go get di mind to respet di Papa wey send di pikin kom.
(En papa and mama tok like dis, bikos dem dey fear di Jew oga dem wey don tok sey, “Anybody wey tok sey na Jesus bi di Christ, dem go drive am komot from di sinagog.”
But wi (wey bi Christian), na only one God wi get and naim bi awa Papa. Na-im kreate evritin and wi dey live for am. Na Jesus Christ bi awa only Oga God. Na-im make evritin and na thru am wi get life.
Bikos pipol wey dey deceive odas, don enter di world; dem nor gri sey Jesus Christ don kom dis world as human being before. Dis kind pipol dey deceive odas and na anti-Christ dem bi!
Anybody wey fit bear rish di end, go wear white klot like dem and I nor go remove en name from my Life Book, but I go tok about am for my Papa and en angels front.