10 so dat wen dem koll Jesus name, evribody and evritin must knee down, weda dem dey heaven, eart or for under di eart
Fero gi-am di shariot wey di pesin afta di king dey ride and e sey, “Make una knee down for am!” So Fero make am oga ova all di land for Egypt.
Kom! Make wi go woship and bow to am. Make wi knee down before God wey make us,
As Jonah dey inside big fish belle for three days and nites, na so Man Pikin go dey for grave for three days and nites too.
Dem take shuku-shuku make crown wear am for en head, put walkin stik for en hand, den knee down for en front kon dey laf am dey sey: “Make una hail Jew pipol king o-o!”
Den Jesus Christ waka near kon tell dem, “God don give mi all di pawa wey dey heaven and eart.
Na wish ansa God gi-am? E tell am, “I still get 7,000 men wey neva woship Baal juju at-all.”
God go komplete en plan wen di time don rish, den E go gada evritin wey dey heaven and eart togeda under Christ, wey bi di head.
Bikos of dis, I dey knee down for awa Papa front,
Na wetin dis word, “E raiz-up,” mean? E mean sey Christ first die and dem beri am for di eart.
But wen God won send en first-born enter dis world, E sey: “Make all my angels woship am.”
And doz wey don die inside sea kon kom out. Deat and grave release di ones wey dey inside dem and God judge dem akordin to wetin dem do.
di twenty-four eldas go bow woship di Pesin wey dey live forever and ever. Dem go remove dia crown put for en throne front kon sey:
But nobody for heaven, eart or under eart fit open di book or look inside.