Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Filippians 1:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 So e dey good for mi to dey tink about una like dis, bikos una dey my heart. Una don follow mi share from God favor, even wen I dey prison and wen I dey prish di trut about di gospel.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Filippians 1:7
34 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

escept sey di Holy Spirit dey warn mi sey, from town to town, na prison and sofa dey wait for mi.


Den di kommanding offisa arrest am kon give orda sey make dem tie am with two shain. E ask am who e bi and wetin e do.


Love dey bear evritin and e get faith, hope and patient.


Na di gospel make mi dey do all dis tins, so dat I go fit share for di blessings.


Na una bi di leta wey Christ rite for awa heart, wey evribody know and dey read.


I nor dey tok dis one to kondemn una, bikos I don tell una before sey, una dey awa mind and wi with una go die and live togeda with Christ.


For Christ, e nor matter weda dem sekonsaiz pesin or not; di only tin wey matter, na faith wey dey work thru love.


Bikos of dis, mi Paul wey bi prisona for Christ, bikos of una wey bi Gentile pipol, dey pray give God.


Mi wey bi prisona, bikos I dey serve di Oga God; I dey beg una make una dey live una life as God wont.


I bi God messenja, even doh I dey for prison naw. But make una pray sey, I go dey tok with boldness as I suppose to tok.


My brodas and sistas, I wont make una know sey my sofa na to make di gospel stand.


Di sojas wey dey guide di prison and all di oda pipol don know sey, na bikos of Christ, I dey prison


and bikos of di prison wey dem put mi so, almost all di brodas and sistas faith for Christ, don strong well-well. And naw, dem don dey prish God word without fear.


bikos of how una dey help mi prish di gospel from di first day wey una hear am kon rish today.


Una know how mi and Timoti bi, sey as pikin dey work with en papa, na so e dey follow mi work, so dat di gospel go stand.


But una try well-well as una help mi wen I dey trobol.


Filippi pipol, una know sey, wen I komot from Masidonia, for di time wen I just start to prish di gospel, na una bi di only church wey help mi and na only una dey follow mi share for my happiness and sofa.


Yes, my good friends, I still dey tell una, make una help dem. Dem try as dem dey prish di gospel with mi, both Klement and my oda ko-workers, wey dia name dey inside Christ Life Book.


Mi Paul, dey rite dis greetin with my own hand. Make una remember di shains wey dem take tie mi and make God grace dey with una.


Like dis too, make una dey pray for us, so dat God go give us betta shance to tok about Christ sekret, wey make mi dey prison.


bikos all of una na lite shidren. Wi nor bi nite or darkness shidren,


So make yu dey proud to tok about Christ or about mi wey dey prison bikos of am and make yu use di pawa wey God give yu, take follow mi sofa for dis gospel.


and na dis Good News make mi dey sofa, sotey dem kon put mi for prison like tif; but dem nor fit put God word for prison!


If to sey yu dey here, I for wont make e help mi as I still dey prison bikos of di gospel work.


My brodas and sistas wey God choose, make una tink about dis Jesus wey God send kom and na-im bi di High Priest wey wi bilive.


Instead, make una dey happy as una dey sofa for Christ, so dat wen God go show una en glory, belle go sweet una.


Mi wey bi una fellow elder, wey si how Christ sofa and go share for God glory wey go soon kom, dey beg di eldas among una sey:


As long as I dey, I look am sey e good make I dey remind una,


Wi know sey wi don cross from deat enter life, bikos wi dey love and kare for awa brodas and sistas for Christ.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ