Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Filippians 1:21 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

21 Bikos to mi, to dey dis life, na to live for Christ and to die inside Christ, na dat one betta pass.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Filippians 1:21
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Una don bi Christ friends bikos of God and na thru Christ wi get wisdom, goodness and holiness wey kom from God;


Paul, Apollos, Pita, di world, life or deat; tins wey dey naw or tins wey go dey tumoro, all of dem na una own.


Wi know sey if dis awa house for eart, wey bi awa body skata, God get di one wey wi go stay, wey e bi sey nor bi human being hand build am and e go last forever for heaven.


So, wi dey always get mind and wi know sey, as long as wi dey alive for dis eart, wi nor dey where God dey,


So wi dey always get di mind sey wi go die komot from dis world, so dat wi go-go stay with Jesus Christ for where e dey.


I don die with Christ for cross, so nor bi mi dey live again, but na Christ dey live inside mi. Di life wey I dey live naw, na bikos of di good tins wey God pikin do inside mi, bikos e love and die for mi.


I nor go boast about anytin escept for di sofa wey awa Oga God Jesus Christ sofa and bikos of dat sofa, di world nor mean anytin to mi and I don die to di world too.


Di hope wey I get bi sey, shame nor go ever fit katch mi; my heart go strong well-well and as I dey do naw, na so I go always dey do. Evritin for my body go praiz Christ, weda I dey alive or I don die.


If I kontinue to dey live inside dis body, e mean sey I go do betta work, but I nor know wish one I go like pass.


Naw, I know wish one I go choose, bikos I won go dey with Christ and na dat one betta pass.


Di odas dey busy with dia own matter, but nor bi matter wey koncern Christ.


Wen Christ (wey bi una life) go kom, una go follow am kom with glory.


Den I hear one vois from heaven dey sey, “Make yu rite dis tins: “God don bless pipol wey bilive and obey Christ before dem die!” Di Spirit sey, “Blessing go really follow dis pipol and dem go rest from dia hard work, bikos of di good wey dem do.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ