Na to enkourage una make mi send Timoti, my son wey I like and wey love Christ kom meet una. E go tell una how I dey follow Christ and di tins wey I dey prish about Christ for evry church.
As una don join dey pray for us, na so too God go ansa all di many prayers wey una dey pray for us, den E go bless us and many pipol go kon tank am, bikos of wetin E dey do for us.
But dat one nor matter to mi. So, weda dem dey pritend or do am with klean mind, di message about Christ dey kontinue and na dat one dey make mi happy. I go always dey happy,