Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Filippians 1:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

13 Di sojas wey dey guide di prison and all di oda pipol don know sey, na bikos of Christ, I dey prison

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Filippians 1:13
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Paul ansa, “I pray to God sey, weda na naw or leta, nor bi only yu, but evribody wey dey here, go bi like mi, but make una nor sofa, as I dey sofa so.”


and as dem dey go, dem kon tell each oda, “Dis man nor do anytin wey go fit make dem kill-am or put am for prison.”


Afta three days, Paul koll all di Jew pipol oga dem togeda. Wen dem don gada, e kon tell dem, “My pipol, even doh I nor do anytin against awa pipol or awa grand-grand papa dem tradishon, from Jerusalem naim dem turn mi to prisona kon karry mi give Rome pipol.


Bikos of dis, I kon sey I won si and follow una tok first sey, na bikos of di hope wey Israel get, naim make dem use dis shain tie my hand so.”


So for two full years, Paul stay der for en own house wey e rent and e welkom all di pipol wey kom meet am


Bikos of dis, mi Paul wey bi prisona for Christ, bikos of una wey bi Gentile pipol, dey pray give God.


Mi wey bi prisona, bikos I dey serve di Oga God; I dey beg una make una dey live una life as God wont.


I bi God messenja, even doh I dey for prison naw. But make una pray sey, I go dey tok with boldness as I suppose to tok.


bikos una dey face di same sofa wey una si mi dey face. And I wont make una know sey, even naw, I still dey sofa di same tin.


So e dey good for mi to dey tink about una like dis, bikos una dey my heart. Una don follow mi share from God favor, even wen I dey prison and wen I dey prish di trut about di gospel.


God pipol wey dey here dey greet una too, especially doz ones wey kom from Caesar house.


and na dis Good News make mi dey sofa, sotey dem kon put mi for prison like tif; but dem nor fit put God word for prison!


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ