Wen di thirtint day for di twelft mont (wey bi Adar mont) rish, di day wey dem suppose do wetin di king tok. Na dis day Jew enemies tink sey dem go distroy Jew pipol finish. Instead na Jew pipol kon distroy dia enemies.
So e dey good for mi to dey tink about una like dis, bikos una dey my heart. Una don follow mi share from God favor, even wen I dey prison and wen I dey prish di trut about di gospel.
Filippi pipol, una know sey, wen I komot from Masidonia, for di time wen I just start to prish di gospel, na una bi di only church wey help mi and na only una dey follow mi share for my happiness and sofa.
Yes, my good friends, I still dey tell una, make una help dem. Dem try as dem dey prish di gospel with mi, both Klement and my oda ko-workers, wey dia name dey inside Christ Life Book.