Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Ezra 9:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 Even doh wi bi slave before, Yu nor leave us as slave. Yu make Persia king favor us kon allow us go ribuild yor temple wey skata and make wi wey dey Judah and Jerusalem get peace.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Ezra 9:9
25 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Wen di pipol rish God Temple for Jerusalem, some among di leaders for each family drop ofrin from dia mind make dem join am take ribuild God Temple for Jerusalem.


Ezra go skool and e know di law wey di Oga wey bi Israel God give Moses, well-well. Bikos God dey with Ezra, di king dey gi-am evritin wey e ask for.


Dem komot from Babilon for di first day for di first mont


But naw, awa God, wetin wi fit tok afta evritin wey don happen? Wi don disobey di kommand


Den I leta tell dem, “Make una si di kind trobol wey wi dey face, bikos Jerusalem don skata and en gates don distroy! Make wi ribuild di town wall, so dat shame go komot from awa eye.”


Dem nor gri obey; dem forget all wetin Yu don do; dem forget di mirakles wey Yu do and bikos of dia pride, dem choose leaders wey take dem go back to Egypt as slave. But Yu bi God wey dey forgive. Yu dey good and dey sorry for pesin. Yu nor dey kwik vex and yor royal love nor dey fail. Yu nor abandon dem at-all


Make nobody pity for am; make nobody sorry for en shidren wey nor get papa.


Even doh trobol gada round mi, Yu still kom save mi. Yu protet mi from my enemies wey dey vex for mi and yor rite hand kon save mi.


Wen God don free Israel pipol from dia pain, sofa and di hard work wey dem force dem to do,


E build fence round di land kon remove di small-small stones wey nor go make di vine grow well, den e plant vine put. E build one towa for di middle kon dig pit where e go press di grape put. But as e dey wait, instead make di grape produce betta fruit, e kon produce bad ones.


Naw, make I tell una wetin I go do to my vineyard: I go remove di fence wey dey round am kon break di wall wey dey protet am. I go let animals chop and mash am anyhow.


Dem go ribuild di towns wey skata kon ripair di place dem wey pipol distroy.


“Naw, make yu tell doz wey dey with yu wetin I dey tok so. Na mi send dem go stay for strenj land kon skata dem for evriwhere. Yes, I go still dey with dem for di land wey dem dey.


“So make yu know and undastand sey, ‘From naw wen I tell yu dis message, till di time wen dem go ribuild Jerusalem and di leader wey God choose go kom, e go bi seven weeks and sixty-two weeks. Dem go build di town well again, but wahala go dey for dat time.


“Una dey put mind sey una harvest go plenty, but na small una dey get. Even wen una karry di small food wey una harvest rish house, I go blow dem trowey. Na wetin make mi do like dat? Na bikos my temple skata and all of una dey build fine-fine house for unasef.


God don promise sey na en go bi di fire wey surround di town like wall kon protet en pipol and E go stay der with all en glory.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ